Vous-êtes ici: AccueilAfriqueBBC2021 05 07Article 450666

BBC Pidgin of Friday, 7 May 2021

Source: BBC

President Buhari say some pipo mercilessly dey against Nigeria

President Muhammadu Buhari President Muhammadu Buhari

Some pipo dey try frustrate every goment policy to improve security in Nigeria.

Na wetin President Muhammadu Buhari tell di Presidential Economic Advisory Council today.

Di Council tell Buhari say na security challenge dey affect di kontri economy, as dem meet am during during di 6th regular meeting for Abuja

"Some pipo dey mercilessly against dis kontri" im tok, "we close di borders to control smuggling of petroleum products, and to check smuggled goods, arms and ammunitions."

"Dem still bring weapons enta di kontri, dem bring rice inside di kontri wit motor and okada. I say make dem shoot anyone wey carry illegal AK-47, still dem no stop."