Vous-êtes ici: AccueilAfriqueBBC2021 05 30Article 451050

BBC Pidgin of Sunday, 30 May 2021

Source: BBC

Mali Coup: Buhari travel go Ghana for ECOWAS emergency meeting

Muhammadu Buhari, President of Nigeria Muhammadu Buhari, President of Nigeria

President Muhammadu Buhari go travel go Ghana on Sunday May 30 to attend emergency ECOWAS meeting.

Di one-day meeting for Accra na to discuss di situation for Mali wia di coup leader dia Col Assimi Goïta don declare imself as di kontri president.

Ghana President, Nana Addo Dankwa Akufo-Addo wey also be di Chairman of ECOWAS, na im call for member head of states to come discuss Mali mata.

Nigeria bin don condemn di 24 May coup, plus how soldiers come later detain Mali president and prime minister.

According to statement wey di Nigeria goment release on Saturday, Oga Buhari don already follow meet with Nigeria former President Goodluck Jonathan, wey now dey lead di team of mediators wey go go Mali to try and find solution.

Nigeria foreign affairs minister Geoffrey Onyeama, minister of defence, Maj. Gen. Bashir Salihi Magashi (rtd), and some oda top goment officials, go dey with Buhari for di trip.

Dem go return on di same day, di presidency bin tok.