BBC Pidgin of Sunday, 16 May 2021
Source: BBC
Nigeria Labour Congress [NLC] strike for Kaduna start on Sunday wit total blackout for di north west Nigeria state.
Operators of Kaduna Electric join di five-days-warning strike to ask di state goment to reverse di sack of over 7000 workers.
Chairmo of di state NLC Comrade Ayuba Magaji Sulaiman say dia plan na to 'shut down' di state from Sunday for five days.
Tori be say di goment of Govnor Nasir El Rufai bin take action to reduce di number of workers under Kaduna state pay roll.
Goment say na because di money wey dem dey spend monthly to dey maintain workers too much and e no dey reasonable.
But di leadership of Nigeria Labour Congress for di state, reject di move.
"Di state goment just wake up and decide to sack over 7000 workers, without any notice or severance payment." NLC Chariman tok.
"Dis pipo na human beings too with families and pipo wey dey depend on dem, so na very bad decision.
"Dis na why we dey embark on dis strike and many of our sister unions don ready to join us unless di state goment reverse di sack."
Labour unions under di NLC send circular for different workers associations to join di strike action.
How di strike go affect pipo?
Kaduna Electric don release statement tell all customers say dem go experience service interruption sake of di industrial action.
"In compliance wit di NLC directive, di Transmission Company of Nigeria, TCN don knock off all our 33KV lines inside Kaduna State."
NLC don also ask motorcycle and keke riders to join di strike
For inside circular dem ask di following labour unions to follow down down tool: