Vous-êtes ici: AccueilAfriqueBBC2021 03 26Article 449871

BBC Pidgin of Friday, 26 March 2021

Source: BBC

Joe Biden reveal plan to run for second term as US presido in im first TV press conference

US president, Joe Biden US president, Joe Biden

US President Joe Biden don reveal im plan to run for re-election for 2024.

Di 78-year-old president tok dis one during di first televised press conference e go do since e takeover office for November 2020.

He also announce say im wan make sure about 200 million Americans go don collect di Covid- 19 vaccine before im one hundred day for office.

Di press conference dey come 64 days afta Biden take over di White House from former President Donald Trump.

Tori pipo bin ask oga Biden several questions wey range from di issue of gun controls, migration, economy, among others.

On top di economy, di president say di American Rescue Plan don already send direct payments to more than 100 million pipo and number of unemployed pipo don reduce by 100,000 according to di latest report im get.

Anoda tori pesin ask am how e go fit solve all di problem wey dey face di kontri and whether im presidency go dey successful, if e no get help from di Republicans as well as di Democrats.

Oga Biden reply say Americans elect am to solve problems and di most serious problem wey face American pipo na coronavirus and economy palava.

He add join say im go find solutions to oda problems like gun crime and immigration as dos problems don dey ground before e enta office.

Biden enta di press conference about 15 minutes late and e look tired.

Im tok no too dey fast but e still manage to let pipo know how e dey go.

Joe Biden say im dey fight di pandemic and di economy dey come up.

Biden live press conference on Gun Control

E no too chook mouth for di issue of gun control as e dey all na mata of time.

"Successful presidents know how to time wetin dem dey do. Order am. decide on wetin be priorities, he tok."

Biden live press conference about North Korea

Tori pipo ask am about how e go take reply di provocations from North Korea, wey recently test dia ballistic missiles.

He say dem dey follow dia partners and supporters tok, if di mata pass be careful, dem go respond accordingly.