Vous-êtes ici: AccueilAfriqueBBC2021 05 02Article 450548

BBC Pidgin of Sunday, 2 May 2021

Source: BBC

Imo State: How two men die, six pipo wunjure for Imo state truck accident

Di accident happun as truck wey carri chippings enter busy market for Imo State Di accident happun as truck wey carri chippings enter busy market for Imo State

One truck wey carri chippings lost control enta market kill at two men wunjure six oda pipo for Imo state on Saturday morning.

Di accident wey bin happun around 12 for afternoon, happun for Nkwommiri market, near one Nwangele River for Umuozu community.

According to police statement, di truck wey bin dey come from Ebonyi state loss control sake of break failure as im dey drive down from one hill. Di driver jam two motor and one keke and all of dem fall enta inside di river while di chippings pour on some of di victims.

Di Sector commander of di Federal Road safety Corp Imo state sector command, Adekoye Joshua, tell BBC Pidgin say dem don cari di ones wey wunjure go hospital while dem cari di dead ones go mortuary. Im add say di road don clear for oda motorists to use

Police say dem don arrest di driver.