Vous-êtes ici: AccueilAfriqueBBC2021 03 10Article 449572

BBC Pidgin of Wednesday, 10 March 2021

Source: BBC

Harry and Meghan: Wetin Buckingham Palace tok on di Sussex royal iterview

Di statement dey come on top di explosive interview wey Harry and Meghan give to Oprah Di statement dey come on top di explosive interview wey Harry and Meghan give to Oprah

Di British Royal Family don break dia silence on top of di Duke and Duchess of Sussex interview wey dem bin get with Oprah Winfrey.

For statement, Buckingham Palace release, dem tok say dem dey sad on top how di last few years don dey challenging for Harry and Meghan.

Dem also add say dem go deal with di issues wey dem raise particularly about race seriously, and privately as family.

Buckingham Palace describe di race issues as "concerning" and for inside dia statement, di Palace say dem dey take di "claims very seriously".

Di statement dey come on top di explosive interview wey Harry and Meghan give wia dem point out issues like how tok-tok for di palace bin dey happun on top weda Archie go dey "too brown" as well as why im no get royal title or protection.