Vous-êtes ici: AccueilAfriqueBBC2021 03 07Article 449517

BBC Pidgin of Sunday, 7 March 2021

Source: BBC

Ghana use 4th AFCON U-20 trophy celebrate 64th independence

Dis be de fourth AFCON trophy Ghana dey win since de last one be in de year 2009 Dis be de fourth AFCON trophy Ghana dey win since de last one be in de year 2009

Ghana claim victory as dem 'chew' Uganda to AFCON U-20 finals to celebrate 64th independence.

De president of Ghana, Nana Akufo Addo and de people of Ghana dey celebrate dia 64th independence with continental football trouphy.

Di Gold coast win de AFCON U-20 trophy in a 2:0 victory ova Uganda di same night wen Ghana mark dia independence from British colonial rule.

Dis be de fourth AFCON trophy Ghana dey win since de last one be in de year 2009.

As de U-20 team dey make mother Ghana proud on de pitch in Mauritania, Daniel Amartey scores the winner for Leicester in the Premier League.

Andre Ayew in de 96th minute clings de winner for Swansea. Dis be de wonders wey happen in de world of football for Ghana's independent day.

Akufo Addo congratulate de Black Satellites for en social media page. He tok say "congratulations, thoroughly deserved victory and dem make mother Ghana proud".

De Vice President Dr. Bawumia also make happy take congratulate de players.