BBC Pidgin of Thursday, 1 April 2021
Source: BBC
One high court for Tanzania don sentence one blogger and her husband to life imprisonment for drug trafficking.
Shamim Mwasha dey run fashion blog and YouTube channel.
Dem arrest her together wit her husband Abdul Nsembo for dia home for Dar es Salaam in May 2019.
Tori be say dem allegedly catch heroin for dia hand. Dem charge dem to court and court bin deny di couple bail.
According to wetin tori pipo for Daily news report, di High court Corruption and Economic Crime Division on Wednesday sentence Abdul Msembo and im wife Shamim Mwasha for trafficking 275.4 kilo of Heroin Hydrochloride wey be narcotic drugs.
Di High court judge, Elinaza Luvanda convict di couple afta im consider di evidence wey di prosecution and defence tender.
During di trial, di prosecution wey State Attorney Constantine Kakula lead, dem call eight witnesses to give account. Also di convict dey represented by Advocates wey give dia own defence evidence.