Vous-êtes ici: AccueilOpinionsActualités2021 06 07Article 451162

BBC Pidgin of Lundi, 7 Juin 2021

Source: BBC

Bitcoin: El Salvador legal tender go include cryptocurrency 'digital wallet'

Bitcoin usage don dey grow across di world Bitcoin usage don dey grow across di world

El Salvador president say im go make di Bitcoin cryptocurrency legal tender for di kontri.

If congress support im plan, di Central American country go be di first for di world to formally adopt di digital currency.

Dem plan to use di Bitcoin alongside di US dollar, El Salvador official currency.

President Nayib Bukele say Bitcoin go make am easy for Salvadorans wey dey live abroad to send payments home.

"For di short term, dis go generate jobs and help provide financial inclusion to thousands outside di formal economy," Oga Bukele tell one Bitcoin conference for Florida, adding say e fit also boost investment to di kontri.