Vous-êtes ici: AccueilOpinionsActualités2021 04 06Article 450047

BBC Pidgin of Tuesday, 6 April 2021

Source: BBC

Nigeria Imo State: Gunmen attack correctional facility for Owerri

Di gunmen attack prison for Owerri, Imo state capital for south east Nigeria Di gunmen attack prison for Owerri, Imo state capital for south east Nigeria

One pesin don die afta gunmen attack prison for Owerri, Imo state capital for south east Nigeria.

According to tori, dis wan happun around midnight and e never clear if prisoners escape.

Some footage ontop social media also reveal di sounds of gunfire wey dem fire.

E no dey clear who carry out di attack at di moment.

Our reporter wey dey ground dia say dem shoot one inmate dead as e bin dey try to escape.