Vous-êtes ici: AccueilOpinionsActualités2021 03 16Article 449690

BBC Pidgin of Mardi, 16 Mars 2021

Source: BBC

Oxford-AstraZeneca side effects: COVID-19 vaccine 'blood clot' WHO latest report

A number of kontris don temporarily suspend di use of di vaccine A number of kontris don temporarily suspend di use of di vaccine

Vaccine safety experts from di World Health Organization (WHO) dey meet on Tuesday to review di Oxford-AstraZeneca jab, afta a number of kontris pause dia their rollouts.

Kontris like France and Germany say dem dey act under precaution as reports of blood clots dey comot from some recipients in Europe.

A number of kontris don temporarily suspend di use of di vaccine, plus Germany, France, Italy and Spain.

Dem tok say dem dey pause di rollout following reports of blood clots in some pipo wey don collect di Oxford-AstraZeneca vaccine alias recipients.

Blood clot meaning



Blood clots na solid clumps wey dey form inside di blood, wey fit dey life threatening if dem no treat am quickly. But di WHO say e no get evidence of link between clots and vaccines.

Di World Health Organisation don ask kontris make dem no stop to dey vaccinate.

Di European Medicines Agency (EMA) - di European Union medicines regulator - also dey meet on Tuesday.

Dem don previously say pipo fit continue to dey receive di vaccine.

Oxford-AstraZeneca vaccine side effects [blood clot] - Wetin di vaccine manufacturer tok?



AstraZeneca tok say afta a review of 17 million pipo wey receive di doses for Europe, dem find out say na 37 cases of pipo wey don develop blood clots.

Experts say di number of blood clots reported in vaccinated pipo no high pass wetin dem dey see in di general population.

Oxford-AstraZeneca vaccine side effects latest from Nigeria



Health authorities for Nigeria don tok say dem go continue to dey use di Astrazeneca vaccine.

Di National Incident manager of di Presidential Task Force on COVID-19, Dr Muhktar Mohammed tok: "Our documentation , so far, don show say e dey safe to use."

"Considering wetin dey happun for some European kontris wia dem don suspend or stop to dey use di Oxford AstraZeneca vaccine, for reason wey we never fit confam.

In all of dis issue, we dey look di benefit versus di risk, wetin dem don notice be say dem don administer almost five million doses and only 30 cases don report dis incidents.

Dis incidents dey small compared to even di incidents of di disease itself", Dr Muhktar explain.

E tok say di side effects wey pipo dey worry about, no be wetin pipo suppose dey worried about.

E say Nigeria go continue to dey administer di vaccine and dem go continue to roll am out.