Vous-êtes ici: AccueilOpinionsActualités2021 02 08Article 449430

BBC Pidgin of Monday, 8 February 2021

Source: BBC

Herdsmen/Farmers Crisis: Wetin i go tell Sunday Adeyemo 'Igboho' when i tok to am - Oluwo

Wetin Wetin

Di Paramount ruler of Iwoland in Osun state, Southwest Nigerian Oba AdulRasheed Akanbi don tok say di solution to di issue of herdsmen/farmers clashes for di region na for di traditional rulers to come together and begin dey tok wit one voice.

Di monarch say di problem wey di region dey face na collective responsibility wey everybodi must join hand together to fight.

''Our problem be say Yoruba traditional rulers no dey together''

''Northern Emirs get Northern traditional council, not state council and dem get leader and hierarchy, in Yorubaland Obaship we no no hierarchy dey''

''In Yorubaland hierarchy no dey, your leaders no dey together, your leader dey scatter, e means say if your leaders dey scatter, Yoruba dey scatter''

Oba Akanbi tok say di region must first stop di isuue of foreigners wey dey come buy lands for dia forest and dey use am for bad things.

He also tok say di kontri borders dey porous and dis dey make pipo wit bad intent to enta Nigeria for free.

Oluwo said cattle rearing be private business and e don tell di

According to im ranching still remain one of di best ways wey goment fit use to stop herders from doing open grazing.

''No Fulani herdsmen suppose dey di road anymore, but you n o fit take something from someone without giving dem something back '' E tok.

E tok say federal goment need educate di Fulani herdsmen on ranching.

''If you want do cow business, na your own private business, but education na di key''

When ask whether e think say President Muhammadu Buhari dey do enough for di security of di kontri

Di monarch say e no belief say President Buhari dey pamper di herders for di kontri.

E say herders

Sunday Igboho enta Ogun State to 'chase out killer herdsmen' - See wetin e tok

'Goment need to dey careful on how dem handle Sunday Igboho' - Fani Kayode

Wetin i go tell Sunday Igboho when i see him

Oluwo say di popular Yoruba activist, Sunday Adeyemo wey many pipo know as Sunday Igboho go be one of di good leaders for Yorubaland.

E tok say pipo no need reason wetin e don do in di past sake of say everybody get dia own past.

Oluwo say whenever e gats chance to tok to Sunday Igboho , e go tell am about all di information wey im need.

''Information na di real thing. When i tok to im , i go tell am abouit di information wey e need''

''Sunday Igboho na my son, friend and brother, i go just advise am''

''Make i tell you, evrybody gats work together, we gats work together wit di Fulani, we gats work together wit di goment' Oluwo