Vous-êtes ici: AccueilActualités2021 05 18Article 450840

BBC Pidgin of Tuesday, 18 May 2021

Source: BBC

Kaduna govnor say labour union chief dey 'wanted' for economic sabotage as workers strike dey on

NLC oga Ayuba Wabba and others dey wanted for economic sabotage, El-Rufai bin tok NLC oga Ayuba Wabba and others dey wanted for economic sabotage, El-Rufai bin tok

Kaduna state governor say authorities don declare NLC oga Ayuba Wabba & others from di workers union wanted for economic sabotage and attacks on public infrastructure.

Di govnor tweet say anyone wey know wia e dey hide make e send message to di Ministry of Justice.



Di govnor tweet dey come as di industrial action of workers for di state enta di second day.

Airports, train stations, public schools and hospitals and others dey shut down as other commercial activities dey paralysed as di strike dey on.