Vous-êtes ici: AccueilActualités2021 04 23Article 450388

BBC Pidgin of Friday, 23 April 2021

Source: BBC

Nigerian Comedian, Ada Jesus don die afta battle wit Kidney disease

Ada Jesus Ada Jesus

Popular Nigerian Comedian, Ada Jesus don die.

Harrison Gwamnishu wey dey lead di team of pipo wey dey treat her confam dis tori give BBC on Wednesday.

Di Nigerian comedian Ada Jesus wey her real name be Mmesoma Mercy Obi for interview wit BBC Igbo bin tok say she dey sick wit kidney problem.

For interview wey she do for February 2021, di Instagram sensation bin say e don reach almost one year wey she don dey battle di illness.