Vous-êtes ici: AccueilActualités2021 03 15Article 449660

BBC Pidgin of Monday, 15 March 2021

Source: BBC

Davido hail Burna boy and WizKid win for di 63rd Grammy awards ceremony

Combination foto (l - r) Wizkid, Davido, Burna Boy Combination foto (l - r) Wizkid, Davido, Burna Boy

Nigerian Afrobeat singer Davido don react to Burna Boy and Wizkid Grammy award win.

Burna Boy win di Best Global Music Album category while Wizkid win di Best Music Video for im song wit Beyoncé; Brown Skin Girl, from Lion King: The Gift album.

Dis na di first time dis two musicians go win di ogbonge music award. For inside tweet, Davido say "Whichever way you look am, dis na victory for Nigeria for di culture and di pipo.."

Di singer wey no collect any Grammy nomination add say congrats to our winners! Tule Naija wit emoji of Nigeria flag.

Di 63rd Grammy Awards happun for Los Angeles United States of America on Sunday night March 14.