Vous-êtes ici: AccueilActualités2021 03 04Article 449465

BBC Pidgin of Thursday, 4 March 2021

Source: BBC

Ghana Supreme Court throw out case of Mahama, declare Akufo-Addo winner of 2020 election

Combination foto of Akufo-Addo (l) and Mahama Combination foto of Akufo-Addo (l) and Mahama

Supreme Court unanimously throw out former president John Mahama case out of de window, say errors wey de Electoral Commissioner commit during de declaration and subsequent corrections no be based in any law.

Again, de justices say, de petitioner no present any relevant data to de court for de determination of dia case.

De ruling as read by de Chief Justice of Ghana, Anim Yeboah talk say "de petition is dismissed as without merit".

Wetin Mahama bin want Supreme Court to do?

Lawyers for Ghana's opposition leader, John Mahama petition Supreme Court of de land say make dem order Electoral Commission to conduct second election between NDC and NPP.

Dis be one of de reliefs John Mahama dey seek from de Supreme Court after dem file petition.

As part of de reliefs wey he dey seek for de Supreme Court, he explain say "based on de data contained in de declaration wey Mrs. Jean Adukwei Mensah declar, no candidate satisfy de requirement of Article 63(3) of de 1992 Constitution to be declared President-elect."

Per de 1992 Constitution "A person no fit be elected as President of Ghana unless at de presidential election de number of votes cast in en favour be more than fifty per cent of de total number of valid votes cast at de election."

Based on dis claim say no candidate get over 50 percent of votes, de petitioner, John Mahama dey petition de Supreme Court of Ghana to declare say de results wey EC Boss Jean Mensah announce be "unconstitutional, null den void."

But de EC bin don tok say di petition no hold water as dem say di allegation by de NDC no dey true.

Ghana Electoral laws dey allow political parties to challenge election results den stuff within 21 days after de declaration of results, de NDC dey take dis course on de last day which be today.