Vous-êtes ici: AccueilActualités2021 04 09Article 450128

BBC Pidgin of Vendredi, 9 Avril 2021

Source: BBC

DMX: US rapper DMX don die at di age of 50

DMX die at di age of 50 DMX die at di age of 50

US rapper and actor DMX don die at di age of 50, five days after him suffer heart attack.

Di performer, wey im real name na Earl Simmons, bin don dey on life support for some time but him die with im family by im side.

Di family for di statement wey dem release say DMX "na warrior wey fight till di very end".

"Earl's music inspire countless fans across the world and his iconic legacy will live on forever."