Vous-êtes ici: AccueilInfos du MondeSport2021 05 31Article 451071

BBC Pidgin of Monday, 31 May 2021

Source: BBC

Ghana police arrest man plus im wife for allegedly burying 2-year-old son alive

Di parents bin try to bury dia son at night upon advice of runaway fetish priestess Di parents bin try to bury dia son at night upon advice of runaway fetish priestess

Ghana Police arrest man and wife who allegedly bury one and half year old son alive for di Central Region.

Eyewitnesses say de couple together with one fetish priest meet together at dawn to bury de child.

Abubakari Mohammed, who witness de alleged crime from en room reveal say he see de three outside dey behave strange.

"As I dey de room, I see say some child dey on de shoulder of one of de three people... I realize later say be like dem bury de child" he talk journalists.

"So I report de matter to police wey after police make he dig de grave, we discover say true true dem bury de boy" Mr Abubakar who witness de incident add.

Central Regional Police Command PRO, DSP Irene Oppong reveal say "Abubakari Mohammed report de matter to dem around 3.00am.

"He see Paul Adobaw alias Kojo Okor, who be en landlord together with two women, but heck like dem harm de child."

Police upon de report arrest Paul Adobaw wey dem move am to de crime scene, dem order de suspect to open shallow grave wia dem find de body of deceased son, Yaw Adobaw.

Dem remove de body only to discover after careful examination day blood dey come out from en nose and mouth wey dem deposit de body for mortuary.

De suspect, Paul Adobaw dey inside police custody dey help plus investigations, meanwhile police dey search de so called priestess who dey on de run.

BBC Pidgin dey pick up news say Chief and elders of de area dey pour libation to cleanse de land sake of de claim say dem bury de child alive.

E no be clear why de couple bury to de child alive but some people dey talk say sometimes de child get some deformity that be why dem conspire plus de fetish priestess to kill de child.